Monday 8 April 2013

MY BOYFRIEND MUST MARRY ME PART 2!!!

Choi. I don come back ooo... Make una nor vex say I tey, my girlfriend too like talk. We dey on the phone since day before yesterday ooo. From one topic to another ooo. She first quarrel me say I nor call her on time then she nor gree cut the call. If nor be because today na sunday and her papa force her go GOFAMINT she for nor gree. (Yee pa! Did you just call me a liar? What do u know is the meaning of a lie? Abeg park well)

yes back to my correct people wey dey the bus, (I hope all dose heart breakers don drop for d previous bus-stop ooo) now I never promised you a smooth ride on this bus ooo, there are bound to be mis understandings, differences in opinion, (even twins wey commot from belle same time, opps sorry one after the other still dey quarrel) there will be habits that your boyfriend/girlfriend would exhibit that would make ur head boil(nor worry ice water dey available) however remember our introduction, "begin with the end in mind" so as long as you know you're in the relationship not just for fun but for something way more, it helps you to adjust to your bf/gf's excesses(the holy holy ones go dey complain y I nor use fiance/fiancee now, abeg make una leave me jare, I like the sound of bf/gf) remember you also have your excesses that he/she struggles to cope with. Now make I talk on one tin wey don scatter many naija relationships(I be nigerian na, shey na wetin scatter beyonce oh sorry, foreigner relationship I go dey talk on?) The thing na trust.(Na lie jare, communication na the thing. Because una nor trust una partner nor mean say me I nor trust my own. If u nor trust ur partner wetin u still dey do for this bus??? Are you a learner? There is no relationship without trust so dat one nor be issue.)

Now if trust is the glue that holds a relationship together then good communication in a relationship is what makes that glue potent and very active.(Una dey hear so?) Good communication builds trust as you can only trust what you know very well. Trust is earned and can be earned prior to information known about the person. A relationship where there is no good communication is a relationship heading for the rocks. Conflict in a relationship is virtually inevitable in itself, conflict isn't a problem, how it is handled however can bring people together or tear them apart and lots of times poor communicating skills help tear Relationship apart.(For those of you wey nor sabi speak english make una nor fear, u fit communicate in yoruba! Igbo! Or even hausa! N if u be deaf n dumb all hope is not lost, sign language dey dere.)Well, What you communicate too also matters a lot, sometimes some people communicate fear, anger, shame, failure, lack of love to their mate which is very sad and doesn't help the relationship in any way because what you communicate in a relationship determines how well a relationship will grow.(I get one babe before wey dey always call every 2hours then, "hello love where are you? What are you doing there? Who are you with? Why did u have to go na? Hope grils are not toasting you there? If I catch dem I'll kill o? U know I love you? Are you sure you're not with a girl? And so on... And dis sequence fit happen like 9times in one day. Choi, na relationship or bondage be that one?)

You should be able to communicate love, peace, self control, happiness, caring heart, obedience, in your relationship as these attributes will help it grow faster.(Babes go soon begin rebel because dem nor like to dey obey their bf. Na my husband? Ok dey ask urself, e go do u like film trick) Show me a good working relationship and I will tell you it was built with communication. A spouse that communicates rightly will know what to do when the other is down or sad. Irrespective of how long you have been with each other both of you grow as individuals every single day so good communication helps you understand and catch up with the new developments in your spouse' life.(If u like dey dere de say I'm the quiet type, nor go learn ow to communicate wiv ur guy/babe e go over u, #learner exemplified)

Yeeh ooohhh! Service don end me I dey here dey type. And my pastor like to dey ask me about wetin hin preach.(Omo na to just dey nod my head dey smile this afternoon ooo) abeg I dey go before una put me for trouble, make una sha nor forget say In what ever you communicate make sure you tell the truth ooo... For those of you wey una second name na lie, next bus-stop owa ooo!!!! Make una come down sharp sharp!

1 comment:

Your comment is important to me, Thanks for dropping by